Catholic Bishop Don Yarn Oga Presido Buhari To Stop To Dey Blame Jonathan

Arch-Bishop of Sokoto Dioceses, Mathew Kukah yarn dis tori for dinner for Catholic Bishop Conference of Nigeria (CBCN) 2016 wey Ondo State Governor, Olusegun Mimiko, organize for the International Event Centre,

Im say make Buhari dem stop to dey point dem finger untop the mistake of the Before-before governments,  say the reason why dem vote the new government(Buhari) dem,  na for them to enter and find solutions wey go move the nation forward.

Im com say e better make this administration begin to dey identify the good things wey the Before-before administration don do and start to dey improve on the matta.

Leave a Reply