Police Don Arrest One Man Wey Pour Poison For Im Neighbour’s Pot Of Soup

Police dem arrest Gordon Daniel  yesterday for Ajegunle untop complain wey im Neighbor Saidat Shakiru go tell police say im poison her pot of soup after dem get small Kata-Kata untop NEPA bill wey dem no pay.

When the matter reach police station, Saidat, yan say na only her and Daniel dey the compound the day wey she find say someone don put sinper for her pot of soup, as dem as Daniel wetin happen im come yarn say na devil push am to do wetin him do say na because Saidat dey always yabbis am na why im vex.

Leave a Reply