We Go Sama 20 Years Prison Term To Anybody Wey Marry Small Pikin-Gambia President

Oga Presido for Gambian, Yahya Jammeh don ban pikin marriage wey dey happen.

As im dey yarn some group of Muslim elders for Banjul , im say pikin marriage na illegal thing and im don ban am for Gambia.”

Say if im catch anyone wey marry pikin girl wey bi below 18 years, dem go sama the persin 20 years prison term and the pikin parents wey give the girl hand to marry go spend 21 years for Prison and im add join say anyone wey know about the marriage and no report the matter to the authorities go spend 10 years for jail.

Leave a Reply