Make Una See Toyin Aimakhu Reply To Person Wey Dey Beg For Her Forgiveness

One make up artiste, Amosu Abiodun, @Ladygoldelina wey dey fight with one popular jingo Naija actress Toyin Aimakhu share us photo of Toyin and com dey beg the actress for her forgiveness.

 For her comentry for Instagram she write  say she sorry for everything, for the yama-yama talk wey she don yarn about the actress,  say Toyin na nice and kind person, so she no deserve wetin she don do to am.

Hmmmm!
Una no go believe how Toyin take reply the babe.

My people wetin una tink?
As for mi i respect the both of dem as dem show say them mature gan.

Leave a Reply