My Body Don Dey Kakaraka And I Get Power Beat Anybody Now O! – Buhari

Oga Presido Muhammad Buhari don yarn say im don dey alright and im fit beat anybody wey wan challenge am.

Una know say oga Buhari, travel go UK to treat ear infection, as him come back today, im inspect the guard of honour dem, im com yarn tori people say:

“Una see me when I dey go and una don see me now too, so make una do the assessment yourself.

I don dey alright .
 Una see me sef as i dey inspect the guard of honour.
If una wan fight with me, oya come , but una know say i tall pass all of  you.
My body don dey kakaraka so i bi dey  resume work”

Leave a Reply