Fowl Get Hand For Stephen Keshi Death, And Na Autopsy Go Show Am-Family Members

The family members of the ogbonge footballer Stephen Keshi don yarn say dem don look well well, say fowl get hand for im Kakutu.

The man wey open im mouth for the family Rickey Aburime, say no bi heart attack kill Stephen, say dem go carry im body for autopsy make doctors dem take their ayanya eyes see.

 He yarn say as Keshi kakutu suprise am because im dey do meeting with some of im friends and family members for im house for Benin City, say na there im com sick, so dem rush am go hospital  but e no reach 15 minutes, na im Stephen come comot this world…
Him say the matta dey pain the family well well as their pikin wey dey kick football, come kick bucket.

Leave a Reply