KORRECT MATTA: May 29 Or June 12 Whichone Bi Democrazy Day?

Na APC dem go fit answer dis question!

I salute the ogbologo politicans dem like sir Abubakar Tafawa Balewa, Dr Nnamdi Azikwe and chief Obafemi Awolowo.
Hmmm!  I pray make their soul dey kule with baba God.

For their time enh,  na real democracy we get but today na crazy-demo wey dey see.

Wen PDP government dey for power,  APC dey hook dem for throat say sam sammau 29 na fake, say na June 12 b their own democracy day.

Today wey power don change hand, as APC don dey for power now which wan dem wan choose as Democracy day May 29 or June 12?

I bi wan see how APC go celebrate June 12 becos as e bi so, 40% of people wey dey gor APC now na PDP crossover politicians wey no believe in the spirit of June 12 them bi.

By garri for now oh!!!
Na me, ya ogbonge Big Bros.

Leave a Reply