I No Fit Stop Ekiti Workers, If Dem Wan Strike Make Dem Carry Go-Fayose

Double Whala for dead bodi, as Ekiti State Workers don yari say na strike bi the only solution.


The radical Governor, Ayodele Fayose say e no kuku get choice, and im radicality no reach to stop the workers,  so e yarn dem to kukuma carry go.

Fayose yarn say Ekiti purse don dry like bonga fish, say na only miracle from baba God fit do am or make Ekiti people dem com carry him go Ekiti central market go sell him and use the money pay workers.

Him com dey beg him workers say fowl wey never die fit stil chop corn for future.

Leave a Reply