Association Of Naija Asewo Dey Plan For Strike.

Naija asewo babes wey dey under the umbrella of National Association Of Nigerian Prostitute (NANP)  dan warn say dem wan go on strike.

This asewo association, presido Tamar Tion and dem Secretary,  Sandra Efosa na dem sign the statement wey tori dey yarn. You know as oda bodi for Naija get dre own presido, Secretary and oda estra-esetra, asewo sef get.

Den don come out wit bone face to yarn everybodi say dis fuel increase don bring hardship to their businesses, say their market no they move again.
Say untop say their members dey reduce their market to #500, customers stil dey throw face for one corner.
And dem no wan go gree make government spoil their market pata pata for dem because some of dem b head of their family,  and as their business be dey stil pay tax evn sef wen Oga pata pata for Naija wan enter dem use their body support am for change but dem never see change.

One Response

  1. Anonymous

Leave a Reply