Comot Tonto Dikeh Name From Your Mouth, She No Bi Your Age Mate – Uche Maduagwu Don Warn Uche Ogbodo

Controversial Nollywood actor, Uche Maduagwu don take to Instagram to warn Uche Ogbodo say make she stop todey talk about his crush, Tonto Dikeh.

Some days ago, Uche Ogbodo share one photo with her lover Bobby, her colleage, Rosy Meurer and her hubby Churchill Olakunle, wey bi Tonto Dikeh Before-before husband.

People kon dey talk about the photo she post because some dey think say she and  Tonto Dikeh don fight and she share the photo to annoy her.

Tonto

Uche, for interview with Kemi Falani yarn say:

“We are not enemies but we are not friends. We’ve never been friends. We have never had any friendship connection in the past. Ever since I got into Nollywood, we’ve never been friends. We are just colleagues and to call me her enemy, I don’t think I’m her enemy and I’m sure she doesn’t think I’m her enemy. So, we are good.”

Make Una read wetin Uche Maduagwu write:

“Dear Uche, Na you get your leg and if Na to dey hang out with mama king ex fine, but no bring up her name on this, she no send you a message, all her friends in Nollywood are successful and too busy to dey hang out as spiritual hobby”

post

Leave a Reply