Actress Uche Ogbodo Don Reveal Why She Dey Flaunt Her Baby Bump On Social Media

Pregnant Nollywood actress, Uche Ogbodo don reveal why she always dey flaunts her bump on social media.

Some social media users slam and advise her to keep her pregnancy away from social media but she have refuse listen to them.

Make Una read wetin im yarn for a post wey she share on her Instagram page; 

“Them say make i no show my belle! Nah lie oo! I go shw oo, Infact I go shout am from the rooftop say I get belle!

No be when I born now, dem go say I thief baby or I thief baby picture or I do surrogate. Abeg ooo make unah see me now oo, nah me carry my thing! Beause I no wan hear them shoot bird, im mama fly. When I born na only congratulations.

“Because E Get As Unah Dey Behave for this Social Media 😏😏😏. I no wan hear Yen Yen Yen! Sorry if u can’t read Pidgin, the people I am addressing Understand the message”

post

Leave a Reply