Naija Women Dem No Sabi Wetin Be True Love – Naija Man

One young Naija man wey wan wed his American lover ten months after dem meet for Instagram and fall in love with each other, don yarn say Naija women no sabi  the true meaning of love.

23-year-old Isa Sulaiman and his lover Janine Sanchez, 46, wey bi is a chef for Obodo Oyinbo, California meet face to face for the first time when the mother of two fly go Kano for this weekend.

For interview with BBC Pidgin, the Before-before barber wey base for North downgrade  Naija women dem after im find love with Oyinbo woman .

Make Una read wetin im yarn

“Di truth be say our women no sabi wetin be true love, it is either dem dey eye somthin or dem get plans but if white woman tell you say she love you, bros she mean am from di bottom of her heart.”

“We meet after i start to follow her for instagram and if she post pishure i go like am, den afta small time I come see say some Yahoo boys dey try scam her, so I send her message say make she no mind those pipo so dat tin come attract her, e show her say na honest pesin I be. Na dat one first attract her.”

“From dia we come dey chat wella, video calls and na all dat one lead us to this level wey we dey.”

“We no dey sleep for di same room, i dey stay with her till night before i go tell her good night, even dis one wey we dey do (small hugs and holding hands) pipo dey talk talkless of sleeping together.”

“Afta di wedding for March by God’s grace na US straight for dia I go get work, go back to school na just secondary school i stop and hopefully get soccer team wey i go play for.”

Make Una read wetin the Oyinbo woman , Janine talk about Naija and the bobo

“I don meet im family more dan 100 of dem and e sweet me say all of dem gree for us to marry, many of dem neva see white woman before, na so dem come dey play wit my hair, dey touch my hand.”

“I dey go back by next month and I go return for March for our wedding before me and am go move to America finally.”

Leave a Reply