NFF Don Deny Say Dem Owe Super Eagles Coach Gernot Rohr Three Month Salary

The Nigerian Football Federation (NFF) don deny tori wey dey waka about say the governing body dey owe Super Eagles coach, Gernot Rohr three month salary.

This na after popular sport journalist, Osasu Obayiwana yarn on Twitter on Thursday night say NFF never pay Gernot Rohr his salary for three months,

Make Una read wetin im yarn:

‘ The @NGSuperEagles play match against #SelecaoBrasileira for Singapore, at 8pm Singapore time on Sunday. Gernot Rohr, the Franco-German in charge of @Nigeria’s team, has not been paid his wages by the @thenff for THREE MONTHS.

NFF kon react say na only salary for September dem owe Rohr and they also confirm say Super Falcons coach Thomas Dennerby don tender his resignation.

Leave a Reply