I Believe Say Biodun Fatoyinbo Rape Busola Dakolo, I Get Evidence -Naija Female Pastor, Busola Olotu (video)

The rape tori on Pastor , Biodun Fatoyinbo by Busola Dakolo, wey bi the wife of singer Timi Dakolo never end.

Reverend Busola Olotu, pastor-woman wey Biodun Fatoyinbo take as a mentor, don do exclusive interview with media personality, Adesuwa Onyenokwe, where she reveal say Busola sister, Funmi Ayeni,  come to her in 2011 to tell her how her sister, Busola, dey very troubled after Fatoyinbo rape am. who .

Pastor Olotu who bi lawyer by training, say she talk with Busola that time her sister come with the story and she know say Busola dey talk true as she resemble person wey dem rape true-true.

Pastor Olotu talk again say three members of her church also come out to seek counsel after Fatoyinbo rape them.

Pastor Olotu she also talk for her interview say she get revelation where she saw Fatoyinbo for bed with another sisi and when she challenge him,  im shock, and tell her say im get ”Grace for such things”.

Pastor Olotu say after her revelation, she go meet Fatoyinbo spiritual father, that time, Reverend Emmanuel Oset, and im yarn say ”So he is still doing this thing?”.

Pastor Oset for another interview with Onyenokwe, also yarn say that many ladies dem don come to him for past to yarn same thing  wey Busola Dakolo yarn.

Im kon cut i Fatoyinbo in 2014 after he tried to reach him when the Ese Walter scandal happened in August 2013.

Watch the interview below

 

Leave a Reply