Dem No Born Atiku For Naija – CoS Abba Kyari

Oga Presido Buhari Chief of Staff (CoS) Abba Kyari for his testimony for the Presidential tribunal on Tuesday July 30, don yarn say dem no born Before-before Vice Presido Atiku Abubakar for Naija .

Abba Kyari na one of the three witnesses wey Buhari legal team led by Wole Olanipekun (SAN) call after dem tender 26 sets of documents.

CoS Abba Kyari maintain say Atiku parents dem also qualify to be Cameroonians and say every child wey dem born for Jada and to Jada parents dem na automatic citizens of Cameroon by the French policy of assimilation.

The CoS who yarn say he come from Borno say him no know Atiku grandfather and father even though him bi 67 years old.

Leave a Reply