Of All The Naija Notes Wey We Dey Spend, 100 Naira Na Im Doti Pass 

Naija Central Bank CBN don start new policy wey dem wan use comot all di doti moni wey dey ground.

Dis one mean say dem go replace all di doti naira notes wit new ones according to di CBN Director of Currency Operations madam Priscilla Eleje.
“If una get tia-tia moni, doti moni, carri am go bank, dem go change am for you. But if dem no gree, report dem to central bank,” na so madam Eleje talk.
Di new policy go require anybodi wey get doti naira notes to carri dem go bank so dat bank go change am and CBN on dia own go make sure say dem dey supply clean notes to banks wey dem go dey give out to people.
Talk-talk pesin of CBN Isaac Okoroafor say di new policy go help stop counterfeiting of Naija naira and help make evribodi get only clean-clean naira notes.
“Di policy dey start on Tuesday and evribodi wey get di doti notes fit go change am today,” na wetin Okoroafor talk.
Central Bank say dem dey ready measures wey dem go use punish banks wey no gree replace doti naira notes and di ones wey give pipo old bad naira notes.
How di policy go affect you
Dis new policy go give you right to carri your old or doti naira notes go give banks and dem go give you new onesDi policy go give you phone number wey you fit call to report any bank wey no gree collect your old or doti naira notesDi policy go give you right to reject any doti naira notes wey any bank give and you fit report dem to central bank if dem no gree change di doti naira notesDi new policy also wan make evribodi dey handle naira notes well, make dem no doti, squeeze or spray amFor di new policy, ATM machines no suppose dey bring out doti notes and if you see any ATM wey dey bring out doti notes, report am to CBN.

Leave a Reply