See As School Proprietor And Im Principal Dey Tie Their Students Dem For Cross And Dey Flog Them Untop Say Dem Dey Come Late To School

The proprietor of one school wey dey for Ogun state don enter gobe and dem don arrest am untop say im dey tye two if im students dem for cross as the principal go dey flog them after.

Tori from punch Metro yarn say Afolayan Joseph,wey bi the proprietor of Metorite Standard School for Ayetoro, Ogun state and the principal of the school dey do dis wickedness for students dem wey come late to school and dem con attack and beat one police officer Livinus wey order them say make dem untie the students.


Livinus con call the Divisional Police Officer of Itele Police Station to send officers dem to arrest the proprietor and im principal.

Abimbola Oyeyemi, the state Police Public Relations Officer, don also confirm dis tori say dem go transfer dem to the State Criminal Investigation and Intelligence Department.

Leave a Reply