Naija ogbonge popular jingoo singer and entertainer, Oluwatobiloba Daniel Anidugbe, wey una sabi am as Kiss Daniel, don change im name for im social media accounts to Kizz Daniel.
The singer post photo of himself and write; “Kizz Daniel omo mi.”
Im Twitter handle na still @iamkissdaniel but im Twitter name, also don change ‘Kizz Daniel’.