Barca Don Confirm Say Neymar Jr Wan Commot The Club

Barca don confirm say one of im boy, Neymar wan comot for the club.

The club ogas con give Neymar permission make e no train as hin-waka comot deal with PSG don almost ready. People see am dey comot the club after like 1 hour wey hin reach dere.

For statement wey Barcelona release,dem talk say “Before training start for morning, Neymar tell the people wey dey say hin wan comot for the club to go settle hin future”.

Barca don talk say the condition wey dem go use free am be say the £198m wey PSG wan use buy am, PSG must to pay am finish and say hin contract extension awuf go dey one side till dem settle hin waka-comot deal.

Leave a Reply