Make Una See South African Pastor Wey Give Im Members Flowers To Dey Chop

Pastor Lesego Daniels for Rabboni Centre Ministry Church for South Africa don come again as im dey give im church members dem rubbish to dey chop.

Disi time around,tori yarn say im dey give im church members dem flower to eat for healing.

Im yarn some of the church workers den to go pluck fine flowers from the church alter and give members dem to dey chop am.

Pastor Lesego yarn say as dem dey chop the flowers e dey part of  healing process.Tori yarn say one of the people wey chop am the flowers yarn say im taste mint chocolate. Another say e fresh and e good after eating e don chop am .

 

Leave a Reply