All Of Una Tatafo Wey Say I No Fit Stay For Marriage, I Still Dey Kampe!-Gumsu Sani Abacha

Gumsu Fatima, daughter of Before-before Military Head of State, General Sani Abacha and with im billionaire obodo oyinbo Cameroonian husband jolificate their wedding anniversary on Sunday .She share photos and videos of the anniversary and come write message to her haters dem wey yarn say she no fit last for  marriage.
Make una read wetin im yarn ;

“18 years of marriage no be chinchin o … tolerance.. love… respect.. patience… prayers. To those all those tatafo ppl i still de inside kampe!! Una say i no fit stay for marriage… some say i be ajebutter that i can’t handle it… I heard all sorts of stories some even said e no go pass one week. There’s nothing i didn’t hear.. Nothing ppl didn’t say. Well a lot of una never even see husband up till now…… clap for una selves o!! OLOSHIS. I am here and I will be here forever by God’s grace. In shaa Allah”

https://m.facebook.com/story.php?story_fbid=10155445621782941&substory_index=7&id=542062940

Leave a Reply