Yawa Don Gass!! As Twitter Don Explode With “Keep The Change” Tori

 

This tori sweet me,  as the matta no bi small matta for twitter between two Naija people after dem go for date.


Make i yarn una aw the tori take start…

One Ibadan Twitter user wey im username bi , Ayo@Pabloayodeji carry for sisi @MissMoshiku go outing as im bi tink say after thd outing the sisi go gree for am.

Naso the guy come vex after the sisi no gree  say she go bi im girlfriend come go twitter to yabbis her say after im take her out she no com gree.

 

Make una read wetin im yarn

“Some girls are just mad. You agreed to go on date with me and you’re telling me you are not interested in a relationship”.

 

Hmmmm!!! Kasala com burst, as the babe helep am calculate all the money wey im spent on her for the outing and sharply transfer it back to the bobo Ayo…

The tin wey make the tori sweet bi say na 3,800 the bobo spend but she come transfer N5,000 and tell am make im “keep the change” .

 

Make una see as twitter explode with different hashtags #Ibadan, #keepthechangebae #5kbae sef….

One Response

  1. OsmoziTech

Leave a Reply