If To Say I Bi Naija President, Boko Haram No Go Exist – Abubakar Atiku

Before-before Naija Vice President Atiku Abubakar, yarn say if to say im bi Naija president,  Boko Haram no go dey.

Atiku yarn dis for Yola yesterday November 15th as im dey talk for American University of Nigeria (AUN) IDPs camps for im 70th birthday wey im dey celebrate. 

Im say wen im dey office for 2002, wen one group wey resmble Boko Haram,for Yobe State show their face, dem crush the group immediately. Say to clear Boko Haram,  Naija need steadfast leadership. 

Atiku yarn say if na im bi oga Presido, im for don use all resources wey im get to make sure Boko Haram did no go dey for any part of North-East, say im for don make sure say Naija no go hear anything about dem again, until wen im comot government. 

Leave a Reply