Police Don Arrest One Woman Wey Throwey Her Newborn Baby For Road

Ajangbadi Police Division for Lagos State Command, yesterday September 15th, don  arrest one 31 year old woman, Ifunanya Eme.

 untop say she throwey her newborn pikin for road side around 3am on Tuesday, after two hours wey she born the pikin by herself.

But as God wan catch her, one person wey dey pass after she don leave the pikin for road, come go report to police dem after the person hear as the innocent pikin dey cry.

Police people dem, come go the place, carry the pikin go hospital wey no far, com go do check up for the pikin before dem com go do investigation and com find the pikin mama.

Tori yarn say the woman throwey the baby because she no get money to feed the pikin as the father of the pikin don leave her run wen she carry belle.

Leave a Reply