RIO OLYMPICS: Germany Don Carry Koboko Flog Naija Dream Team.

Water pass garri yesterday for obodo Brazil as Germany tear Dream Team VI slap twice for inside the semi final match wey dem play.

The scoreline na two goals to nothing.
As the match start na him Germany sharpally knack the ball for inside Dream Team VI net and goalkeeper prostrate to catch the ball but him hand no gree reach am.

The team captain, John Obi Mikel been carry sure pass give Sadiq Umar to score but he no just try at all.

For second half na him hope dey say Dream Team go wake up but as dem try to build to score before dying minutes na him Germany strike again.
The result of the match con mean say team naija go face Honduras for Bronze matter.

Many people from naija con dey point accusing fingers give the sports Minister, Dalung say na him carry bad luck go meet the team as he no gree send money for preparation and training on time. Also, plenty people come dey perceive say Germany get luck say Etebo, wey by Dream Team VI prolific stricker wey bang 4 goals for naija first match against Japan no play.

 Nigeria people come dey beg coach Samson Siasia say make he try win the Bronze for the third place match, make him efforts for no just loss.

Leave a Reply