Lagos Government Don Close 70 Churches, 20 Mosques, 11 Hotels Untop Noise Pollution

Management For Lagos State Environmental Protection Agency (LASEPA), don close down 70
churches and 20 mosques, 11 hotels, club houses and beer parlours wey dey Lagos untop noise pollution.

The general manager for the agency, Bola Shani, na im yarn the tori.
Im com yarn say dem no go allow church wey dey use tents and uncompleted building, say the state government plan na to reduce noise pollution reach zero per cent by the year 2020, and dem just dey reach 35 per cent. So,na until dey reach target of 70 to 80 per cent, dem no go stop.
Im say Lagos State na mega city, so noise free na the way forward.

Leave a Reply