Buhari 2nd Term With 2nd Lady ‘New Wife’ ?

Tori don dey waka about say  Hajia Sadia Umar Farouq na the new wife wey go get married to oga presido Muhammadu Buhari by tomorrow.

Dis wan wey Oga Presido Buhari yarn say im been dey work so hard for Naija say na why im get cold and we no see the results of the work wey im dey do maybe im been dey spend time to woo Hajia Sadia Umar Farouq to be his new wife.

The current Nigerian first lady, Aisha Buhari dey very angry at how the cabals dem dey control her husband and she been dey protest against the cabal and establishment for Aso Rock.

Hajia Sadia Umar Farouq na social status climber, she always get “relationship” with oga presido Buhari as she bi the founder of a ground wey dem call the Buhari Support Group (BSO), wey champion the campaign for Buhari’s re-election campaign.

Dem Give She her ministerial portfolio for the new government after the successful campaign and now she wan kon get another  reward with the office of the first ‘2nd’ lady of Naija.

Latest tori bi say Aisha Buhari don move out of the Aso Rock months ago after another disagreement with the cabal.

Leave a Reply