#AFCON2019: Super Eagles Dem Don Go On Strike For Egypt Untop Say Dem Never Pay Their Allowance

The Super Eagles dem dey for strike for Egypt untop allowance wey dem never collcoll.

Dis na Tori from BBC Sports Journalist, Sulaimon Folarin, say the footballers dem wey dey for Egypt for AFCON2019, no gree  train today June 25th .
The footballers say dem never settle dem of their bonuses  of $10k per player money for the 1-0 wey dem win over Burundi.

But NFF president Amju Pinnick don yarn tori men for Egypt say dem get the Naira value of the bonuses to pay, but the players dem don refuse collect am, because the official conversion rate for USD dey lower than the open market rate, wey mean say the players dem go lose money.

Leave a Reply