Make Una See Serious Gobe As Witch Doctor Don Expose Cheating Husband With Im Sister-In-Law  (Video)

For Kenya on Tuesday June 6th, tori yarn say a 55-year-old man gum-gum together after sex with im wife sister (sister-in-law) for hotel.


Tori for Nairobi  yarn say the man wey get 5 pikin comot house for Kisii say im dey travel to Mombasa to go buy car for im family after im don sell one piece of im land, but na one hotel for Nakuru im come go to meet im wife sister wey bi student, na there both of dem come meet dis kasala wey burst as dem no fit stand up from untop eachother after dem gum togeda.

The wife of the man, Ms. Margaret Nabwire yarn say she go witchdoctor place to do charm for her husband to expose him, after her neighbors don tell her say her husband dey cheat on her. She com talk say before she go separate both of them she go collect correct money.

“I have been married to him for more than 20 years and we have five children. Today l decided to teach him a lesson. I paid the witchdoctor Sh 40,000 for assistance,”

Dem come carry both of dem go witchdoctor, wey her name bi Annet Mutheu, was.
she com yarn say she use ‘kamuti’ with the name of the wife or husband and tie it with a string until dem catch any of them cheating .

Make una watch video…

Leave a Reply