Police Don Arrest One Man Wey Dey Sleep With Im 15 Year Old Pikin

Police for Lagos State command don arrest  Uchenna Elumadu, untop raping matta.

Tori yarn say im dey sleep with im 15 year-old, JSS 3 daughter and im bi dey give the girl drug so that she no fit carry belle.
Say the man go dey go wake the girl up for midnight and come sleep with her.
Dem yarn say na anytime the girl mama go night duty, as the woman na casual worker for one outfit wey dey airport,  na im the man dey do the nonsense.

But has God go catch im,  for night of Sept. 19, na im the girl mama catch im as im dey do her pikin and come shout,  naso their neighbours come go report the matta to police.

Leave a Reply