Gbege Don Happen : Arizona Tv Reporter Don Commit Shitiry

Our elders go yarn say, if you bend down look another man yansh, another person for yonda too dey look your own.

Hmm! Police don arrest one Arizona Tv Reporter Jonathan  Lowe for committing shitiry.
Tori yarn say person see Jonathan as e dey off load shit for another person yard, naso the person com go call police for am.

Jonathan com tell police say he no too dey alright and no fit hold the shit na why him do wetin he do.

Tori com yarn say,  Jonathan go pay fine of $2,500 or dem go sama am prison and him go stay there for 6month.

My people dis one na expensive shit o, abi wetin una think?

Leave a Reply